
Wetin dey sup? Naija, my dear land,
Where hustle tight like Eba way Precious make.
From morning till nightfall,
We dey chase dreams wey way we no day see.
Our president? Oga T-Pain,
Not because e dey sing, but e dey show us pepper.
Dollar dey rise, naira dey faint,
We don dey use vibes as currency paint.
Nepa no gree show face,
Generator sef dey join rat race.
"Up NEPA!" Na national anthem,
Mak I Paste AZA? Abeg, who go blame dem?
Fuel queue long pass Third Mainland Bridge,
If you see am, you go wan trek go village.
Subsidy don japa, na wetin remain?
Just vibes and hope inside our pain.
Police go stop you, "Oga, how far?"
"Anything for boys?" Naso dem go start wahala.
Sapa dey follow everybody like birth right,
Even Japa plan don turn big event.
ASUU strike? Na year-long holiday,
Youth dey graduate, future dey delay.
Yet dem go tell us, "Education be key,"
But which door, abeg? Make dem explain to me.
Traffic na Lagos native dance,
Bumper to bumper, na car romance.
Danfo drivers with their wahala,
"O wa, o wa!" We still dey hala.
Before dem carry us go where we no know.
But Naija spirit no dey ever break,
We go laugh our tears like e no be mistake.
Even T-Pain no fit collect our joy,
We dey find happiness like pikin find toy.
So my people, no let life wound you,
Make we just day watch our tiktok,
We dey waka, even if the road dey screw.
One day we go blow, Naija go shine,
We Pray to God, Make we no jam Person like sam larry.
Make Asake day give us vibes,make we no go resemble Zinoleesky.
Make Naira Marley no see ujs kill.
We still day pray..
(Add in Comment)

Comments
There are no comments for this story
Be the first to respond and start the conversation.